Full width home advertisement

Post Page Advertisement [Top]


My dear people how una dey naa!!,I can hear u say dis talk talk don cum again,u no go blame me,na make food for dey table..
 Oyibo say one constant thing in life is change and rebranding 4 good, hmmmm!!no b small problem ooo..everybody don take d matter personal ooo..
 People we know as Carpenters don rebrand, dey r now called furniture makers
 Ndi yahoo yahoo say dem b G-boiz
 Tailors say dem be fashion designers

 Babalawo say him be traditional fortuneteller
 Dry cleaners say dem be laundry consultant..hmmm!!
 Vulcanizers say dem be highway engineerz..jesu!!
 Bricklayers say dem be building contractors..nice one!!
 Even agberoz say dem be commercial tax collectors..abasi mbong!!
 Even beggars be like, pls help me,I'm not a beggar oo,I'm just a victim of circumstance..oyibo!!
 Even ashawo dey call themselves commercial sex workers..some even got complimentary card, sote nowadays u dey book ashawo online like say na flight schedule..ww.ashawo...dats all...may God help us all in this country ooo..do have a nice week ahead jare..Oluwa bless ur Rebranded huzzle..mC FiLoSOphER(C.F.R)..

5 comments:

  1. Loool @ ww.ashawo

    ReplyDelete
  2. ...Even barber dey talk say dem b "hair-stylist"....@mc......I haiL ohhh!!!.....even comedians dey talk say dem b humour merchant!!!!

    ReplyDelete
  3. Humour marchant,infigurated commedian of the federal republic of 9ja....

    ReplyDelete
  4. Filo u no go kill person loI na choco gentle

    ReplyDelete

Subscribe

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...

Bottom Ad [Post Page]

| Designed by Colorlib