Full width home advertisement

Post Page Advertisement [Top]

How una dey..jokes apart ooo..jux reason with me..
I jst Notice say Life too short to commit suicide or to dey depressed cuz In the year 2002,nokia 3310 na N75k with N40k econet simcard, but today na N700 and the sim na free..
In 2003 samsung c100 na N48k and U must recharge with atleast N1500 airtime every... two weeks or else dem go block ur sim..

Today na N800 and I no even need 2 buy recharge card{customer scarce}!!...
In 2004 sendo x with camera and 16mb memory card {u remember d phone naa} na N39k den, today dem dey use d fone do promo..
In 2006 sagem my v55 na N30k today na N300...
2008 nko??? blackberry bold 2 na N135k(hmmmm)
today blackberry no dey produce new bold 2... so London used na N15k.. U can get 9ja used for N6k(can I hear u say I luv my country)...
So my friend, if u neva dey use blackberry porch, htc smart phones, android, ipad,
iphone, playbook or nokia 808, no just worry.
Just wait and see, coz before 2015 dem go dey use am 4 phone boot as pay phone..
E jux dey make me reason y some girls go go extra mile jux bcos of material tinz.
U want a bold 5,
U want brazilian hair,peruvian hair,indian hair,22 inches high hillzz,
U want LV bag,some go even stand 4 highway by 2am,u dey craze??..kai!!I even hear say dem dey book ashawo online nw..ww.ashawo...dats all..na flight??
Remember say Beetle na d richest car dah year!!where u dey see d car now
My Dear, BEAUTY dey FADE
WEALTH dey VANISH
But d negative tinz wey u do now 2 get all dis tinz go hunt u till 6ft..relax..huzzle..comport urself...use ur head..dey loyal..put our oga @ d top first..I bet yhu all oda tinz go follow..A word is enough 4 d wise..Bless yhu!!..MC FILoSoPHER(C.F.R)!!

5 comments:

  1. I dey believe you !!! Bigger you bro !

    ReplyDelete
  2. Oboi yur head dey dere...feelin u frm cally town

    ReplyDelete
  3. @phyl.... So you know dat code** lol*** kapish lamakunta !!!!

    ReplyDelete

Subscribe

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...

Bottom Ad [Post Page]

| Designed by Colorlib